When She Call You Broke for Cameroon… Chill She call you broke? Abeg chill — that word no fit kill man wey get vision.
You sabi that kain vibe you ask your guy for borrow you “i seh eh pah lend me 2k or 5k” before yoou even finish complete stament that one word go turn wahala? Even if you plan pay am back, my own case be be nah my baby she go act like say you commit crime.
For her eye, real man na only if e get car, house, or dey for USA/Canada dey send iPhone(Ok we know say japa na different level better dey that side but this na 21st century different income streams dem dey even though paye fit fustrate person). Anything wey no reach that Odogwu level? “Na broke guy.” your whole life get for be Odogwuwish
But if she call you broke for Cameroon, no let your chest rise. E no be new. No vex. Just yawn.
Why? Because you don outgrow that mindset. You sabi wetin dey happen behind the scene.
She Call You Broke? Ask 2k No Mean Say You Broke
Borrow small cash no mean say you broke. Na hustle stage you dey. You dey build. You dey grind.
But some people think say if you no dey throw money or send daily momo, you no be “man enough.” Dem prefer make you dey suffer silent than admit you dey for grind phase.
Na small mindset be that. No measure yourself by am.

People wey dey call you broke dey use shallow measure:
- How much cash dey your pocket that day.
- If you don japa like their cousin for Europe.
- If you dey form fake “big man” with bottle popping.
But true value no dey for that. Maybe you dey sell thrift for Buea, design software for Bambili, or dey cut hair for Bonaberi. Na real hustle.
Your plan and vision pass their shallow eye. You no need their validation.
She Call You Broke? You Don See the Pattern beefore
E no be today matter. Na pattern. And once you sabi am, e dey boring:
- Dem look down on you because you dey hustle local.
- Dem think success only dey for abroad.
- Dem confuse your today position with your final destination.
That aunty for wedding wey dey size you because you no spray bundles, that babe wey laugh say you still enter taxi? All na noise.
You sabi who you be, and where you dey go.
Your Sense High Pass Their Insult

If your mind and spirit mature, you sabi say:
- Vision dey take time build.
- Brand and skill dey grow brick by brick.
- Nobody dey poor forever — life fit turn quick for person wey grind steady.
This awareness dey make you bulletproof. You sabi say your tomorrow big pass your today.
And you no dey die for validation. You fine, you get plans. When pocket and purpose align, partner wey value you go show.
Na Your Grind Go Answer Them
No need clap back. No need argue. Actions go talk pass your mouth:
- Hustle your hustle, even when nobody dey watch.
- Grow your skill and brand. Money go follow.
- Build your CV and connections brick by brick.
- Pray, stay focused, avoid shortcut.
One day na you go dey drive your own motor, run your own business, even hire the same people wey once call you broke.
Na success go talk, no be insult.
Final Word: Yawn, No Vex
When person call you broke, e dey drain. But no vex. Just yawn.
Because their mindset small. Na projection. E no fit define your destiny.
i no want tell wonna my own personal experience them that one na story for different day put your comment for down dey if you want make i yan you better gist next time.
Stay grinding. Stay focused. Na your results go talk. And trust me — the same mouth wey call you broke today, go hail you “Boss!” when your grind show tomorrow.