Gold digger talk no be theory — na real life gist. One morning, my female friend wake up send me message say: “Man pikin yi responsibility na for supply money, while woman own na for receive am. Woman no suppose borrow money from man; she suppose take without repay.”
I just laugh. I no block the girl, I ghost yi small. Few days later, another one tell me say the way I dey do things na surface level — I no be “odogwu.” Why? Because I dey buy data 1k, 2k, 3k instead for buy iPhone, fine shoe, pay rent, or pop champagne. As I dey talk so, na the same girl ghost me, call me stingy, even talk say I be the type wey go count how many times I give woman money.
But wait — why I no suppose count? Why giving suddenly turn to obligation? Why relationship don turn to transaction?
This na the raw truth: in Cameroon today, plenty relationships don shift from love to money games. And if you no shine your eye, you go confuse fake love with destiny love.
🎠When Love Turn Business
For Cameroon today, love don change format.
For our parents’ time, love mean respect, patience, and building future together.
Now? Sometimes e don turn business partnership with feelings attached.
You subscribe, she smile. You stop, she vanish.
No be say all girls na gold digger o inffact i no be want use that word i be one use money minded but boys them don over cry so i say make we hit hammer for head — far from that.
But make we talk truth: the way some relationships dey go now, e be like say many babes no dey date you, dem dey date your momo account.
Gold digger “Good Morning, My Bundle Provider”
If every sweet message dey land only when she need airtime or data, bros, shine your eye.
Some babes no dey say “I miss you” — dem dey really mean “I miss my 500 CFA bundle.”
You go notice say when transfer stop, conversation dry like harmattan throat.
The “Seriousness Test” Scam
Cameroon girls don master this line:
“If you really love me, show it.”
Show it how? With momo. Wether na camtel or mtn or na orange money just momo me(camtel no get momo ohh)
they call am say test of love, but you know say na test of pocket.
Once your account dry, she go ghost na you go dey send hey wassup text for morning time.
TikTok Love & Artificial Lifestyle
TikTok don confuse plenty relationships.
1k followers don turn to “celebrity.”
Ring light, wigs, bleaching, all join — yet no real plan for future.
You go dey there funding lifestyle wey no get vision, while she dey use your data film content about “independent women.”
đź’” When the Momo Stop, the Love Stop
Na the easiest way to catch a gold digger.
Stop sending momo for one week.
If she still call, gist, and care, you fit get hope.
But if she disappear like she never know you, congrats bros — you just escape financial heartbreak.Infact my own case be worst i mean am say i must get something in return 1 way or another, so i start dey beg netflix account, start beg bottle groundnut, that girl just wise say this guy go hard for release.

Kingsley Okonkwo’s A to Z of Marriage is a must‑read guide for building love that lasts — practical, faith‑rooted, and deeply relatable.
Discover on AmazonThe Trap We All Dey Inside
Truth be say, some girls no even wicked — dem just dey trapped for system wey confuse love with survival.
Economy hard, TikTok dey push fake life, and culture dey pressure women to find “sponsor” instead of soulmate.
But pity no be reason to stay.
If she no fit build with you, she go drain you.
The Kind Babe You Really Need
You no need gold digger/Money eye. You need a builder.A good woman infact truth be say you attract wetti you be that mean say no go after something way no reflect your own good quality if you good then find babe wey good pass your pa and mami seff because i sure say na from them you get that quality so if you dey struggle for make babe for reflect your good quality then problem dey, atleast balance must dey, then wonna two grow.
Girl wey fit brainstorm brand ideas with you, pray with you, plan business with you, and still make you small garri with groundnut when pocket dry.
That one no go see you as ATM — she go see you as partner. Imagine say you be na banker caame back from work want talk about how you crack some loan today before you finish talk baby don skip go na for i want yogurt today, or pastor you want talk about that dream way God pour oil for your head but baby dey switch topic to how way cardi b dey go court.
Comparison Na Silent Manipulation
If every conversation na “see how that guy buy phone for his babe,” abeg take note.
She no dey see you — she dey see what she fit collect from you.
That one no be love, na hustle.
if all discussion na say my ex be over sped for me sutey i be start for vex, my brother shine your eye
đź’Ľ When Promotion No Mean Anything
You go tell her say you get promotion, she go just ask, “So how much dem add?” see my own uncle no congratulate e woman when e woman get promotion first thing my uncle ask ” i seh ehh that mean say the salary na how ehhh” and na the most irresponsible uncle that for my family
Bros, if your growth no dey impress her except e involve momo, na clear sign say you dey inside business, no be relationship.
🕯️ Spirit No Dey Lie
Sometimes, your body fit still dey enjoy, but your spirit go whisper: “This love no clean.”
When peace no dey, no force am.
Because once spirit reject, even prayer no fit save that union.
đź’€ Fake Love Dey Drain Energy
Gold digger love dey sweet for beginning but e dey dry your purpose small small.
You go spend more, think less, and end up broke and confused.
Real love dey give peace — fake love dey give panic.
You no suppose dey check balance before you sleep every night because woman ask for “small thing.”
How to Spot Real Love From Gold Digger Love
Real love dey celebrate your progress, no just your pocket.
She dey call when you broke.
She fit still cook, pray, or encourage you even when nothing dey.
That one no go ghost because bundle finish.
Gold digger love dey sweet at first but e dey cost more than rent.
Once you stop sponsoring, connection cut.
Final Word: Filter, No Hate
No be every Cameroonian girl wey fine and like good things na gold digger.
But the ones wey run only when your momo dry don already expose themselves.
No vex, no cry — just thank God say you see am early.
Because real love no dey hide inside receipts.
Real love dey show inside action, vision, and peace of mind.
When you meet that one wey fit pray with you, dream with you, and build with you — you go know.
Her love not need Momo subscription; her presence alone na the real blessing so my guys them i know say wonna no stingy na condiion make njanga back bend but no condition is permanent put more effort and call papa God for Heaven for give you Success and wisdom for overcome and you go be boss with another boss baby for your corner wey go still call you say Grand we do how i dey follow your lead.
This Steve Harvey classic is pure gold for anyone navigating love and money.
Discover on AmazonStarting a Startup: Build Something People Want is a must‑read playbook for dreamers who want to turn ideas into movements and products into impact.
Discover on Amazon



